Click here for spoken version

Pipul de tek di wod ‘Naija’ tek kol di nem of plenti difren-difren tin. Som taim dem go yuz di nem ‘Naija’ tek tel yu di nem of di langwej we dem de kol ‘Pijin’ kom rich tude. Som taim pipul go yuz di wod ‘Naija’ as di nem of won kontri dem de kol ‘Naijiria’ kom rich tude. Bot bifo eni langwej bin dey we kari di nem ‘Pijin’ o ‘Naija’ and bifo eni kontri bin dey we kari di nem‘Naija’ o ‘Naijiria’, for som Afrika langwej sef, pipul bin don de yus dis wod ‘Naija’ finish de tek kol di nem of won ‘mama of evri riva’. Dis ‘mama of evri riva’ na di Riva Naija we de enta Naijiria from Kebbi for west de ron go ist join di Riva Benue for Lokoja, and afta, de ron go saut sote im rich Atlantik solt wota komot for Bini and Pitakwa.


Leave a Reply